fbpx
September 29, 2024

2023 polls: Rivers ex-Chief of Staff, Okocha don deny attachment with Wike, and hin commit to Tinubu

okocha-deny-attachment-with-wike-and-hin-commits-to-tinubu

Di former Chief of Staff to di Rivers State Government and member of di Tinubu/Shettima Presidential Campaign Council for Rivers State, Mr Tony Okocha don deny allegations say hin dey work with Wike to spoil di efforts of di All Progressive Congress, APC, executives for di State.

Also, Okocha deny di speculations wey yarn say hin still dey attached with Wike di Social Democratic Party, SDP, for di State and hin commit to Tinubu.

Di immediate past Chief of Staff to di Rivers State Government dey on loggerhead with di APC leadership for di State.

Some pipo also allege say Okocha dey work for Governor Nyesom Wike to cause more chaos for di main opposition party for di State.

FOR MORE NEWS: Provide evidence I go quit presidential race – Obi don open up on allege N2bn bribe to CAN

Di leadership of di APC for di State bin refer to am as a member of a non-Governmental Organization, wey no support dia presidential candidate, Bola Tinubu.

Okocha follow claim say di Governorship candidate of di APC for Rivers State, Patrick Tonye-Cole no gree canvas for votes for di presidential candidate of dia party. This na  allegation wey di State APC leadership deny

Two weeks ago, some members of di PCC wey Okocha lead, stage walk out from di PCC meeting after di disagreement with di former Director-General of Port Authority, Sokonte Davies wey head di meeting.

But when di Presidential Campaign Council of APC for Rivers State go for di inspection of di Yakubu Gowon Stadium, Port Harcourt for di Presidential campaign rally, wey dey scheduled to hold on February 15th, 2023, Okocha yarn say hin be member of di All Progressives Congress, an hin be founding member.

According to am, na Chief of Staff hin be when di party first come together for Rivers State. Also, hin talk say hin remain committed to di party norms, di party rules and guidelines.

You fit go read di full tori…READ MORE