fbpx
May 18, 2024

Fans dey buy Osimhen mask as striker equals Higuain record

fans-buy-osimhen-mask

According to di reports from La Gazzetta dello Sport, Napoli fans dey in love with Victor Osimhen to di extent say dem no only queue to buy hin shirt but also replicas of hin protective mask outside di Stadio Maradona.

Di Nigeria international na Serie A’s leading scorer with 17 goals for 18 matches, including eight for hin last six appearances.

Hin bag one for Sunday 3-0 win against Cremonese and Gazzetta. Also, di protective mask wey hin dey wear for  more than a year now because of di cheekbone injury wey hin suffer against Inter in November 2021.

Replicas of Osimhen mask dey on sale in stalls outside di stadium and hundreds of fans dey queue to buy di gadget on Sunday, before dia game with Cremonese.

FOR MORE NEWS: Careca dey compare Osimhen to Pele

They top Serie A with 59 points after 22 games, and dem lose  just one league game — against second-place Inter milan — This na as di chances of di first league triumph after three decades look bright

Meanwhile, di 24-year-old continue to equal and break records for Italy as hin still dey enjoy hin blistering performance.

On Sunday, Osimhen scored Napoli second goal for dia 3-0 win over struggling Cremonese and to do so, he become di club second player for dia  history to score for six consecutive matches after Argentine Gonzalo Higuain, wey do di same during hin time for Napoli for di  2015/16 season.

You fit go read di full tori…READ MORE