fbpx
September 30, 2024

“No Be by Tribe O”: Cubana Chiefpriest don Finally Reward Boy for Viral Peter Obi Photo, hin advise Others make dem Donate

chiefpriest-don-finally-reward-di-boy-for-peter-Obi-Viral-photo

Popular Nigerian socialite, Cubana Chiefpriest, don fulfill hin pledge to Yusuf Alabi, hin don finally reward di young boy wey dey for di photograph of Peter Obi Lagos rally.

Remember say di socialite bin react to di viral photo and hin ask pipo make look for di boy because he wan change hin life and hin wan comot am from street.

From di new development, Chiefpriest don locate di boy and e don Finally Reward di Boy after he follow am tok. Di update don make plenty Nigerians on social media dey happy.

FOR MORE NEWS: “Hin Story Don Change” Cubana Chief Priest Don Vow To Make Di Teenager Millionaire As Hin Stand In Front Of Peter Obi Convoy

Taking to hin Instagram story, di socialite share a series of posts of Yusuf. One na screenshot from dia video call together as Chiefpriest brag say e remain small make di youngster become millionaire. Another post show Yusuf and hin mother with other well-wishers.

Cubana Chiefpriest share another post for hin page of Yusuf as hin hold paper with hin name and bank account details. Also, socialite call on well-meaning Nigerians make dem join in donate for di youngster so that hin go comot for streets.

According to Chiefpriest, Yusuf dey too young to be truck pusher and to dey do offloading jobs.

Hin yarn say “Grace Found Him, na so hin beg others say make dem help comot Yusuf for Streets.

You fit go read di full tori…READ MORE