fbpx
May 17, 2024

Rivers: Abe don withdraw petition against victory of PDP from tribunal

abe-don-withdraw-hin-petition-against-Tinubu

Di governorship candidate of di Social Democratic Party, SDP, for di just concluded elections for Rivers State, Senator Magnus Abe don withdraw hin petition for di Election Petition Tribunal against di victory of Siminalayi Fubara of di Peoples Democratic Party, PDP.

Senator Abe drop dis update when hin dey address party leaders for hin campaign office for Port Harcourt on Sunday.

Di former senator yarn say hin decision to withdraw di petition against PDP Fubara na for di interest of Rivers people.

 

FOR MORE NEWS: Adamawa election: ‘I bin dey under pressure’ – Suspended REC, Yunusa Ari don break silence

 

Also, hin dismiss claims by Rivers State Governor, Nyesom Wike, wey tok say hin dey de-market di state with hin comments after di election, and hin dey seek appointment under di administration of di President-elect, Bola Tinubu.

Abe insist say di activities of members of di PDP for di office of di Independent National Electoral Commission, INEC, after di election as well as di killings during and after elections na di kinds of actions wey dey de-market di state.

However, hin appeal to di President make dem address di issue of fuel subsidy, and hin tok say di postponement of di issue no dey in di  interest of di Nigerian people.

You fit go read di tori as Abe don withdraw hin petition…READ MORE