fbpx
May 5, 2024

Activist Timi Frank tackles Akpabio over ‘vacation allowance’ to lawmakers

activist-frank-tackle-akpabio

Activist Timi Frank, don tackle di Senate President, God’swill Akpabio, over hin statement wey hin tok say di National Assembly don send money to all senators make dem enjoy dia annual vacation.

Frank tok on di development inside video recording on Wednesday.

He describe Akpabio revelation on live national TV as a mockery of democracy and Nigerians, also, hin call on di Senate President say make hin resign hin position immediately.

According to Frank, it dey insensitive for di lawmakers to enjoy national resources in di name of holidaying for time wey Nigerians dey face hardships and other economic challenges.

 

FOR MORE NEWS: Japan mark 78th anniversary of Nagasaki nuclear attack

 

Remember say Akpabio, on Monday during special plenary session of di screening and confirmation of President Bola Tinubu’s ministerial nominees, inform di senators say di Clerk to the National Assembly (CNA), Magaji Tambuwal, don wire money go dia individual bank accounts make dem take am enjoy dia annual holiday.

See wetin Akpabio tok, “In order to enable all of us to enjoy our holidays, a token has been sent to our various accounts by the Clerk of the National Assembly…,”

However, di Senate President statement meet with interruptions from di senators, wey bin no dey satisfied with Akpabio’s public disclosure.

Akpabio later pause as hin withdraw di statement, rephrase di information.

You fit go read di tori see as Activist Frank tackle Akpabio…READ MORE