fbpx
December 22, 2024

Noboby suspended me from NNPP – Ebonyi guber candidate, Adol-awam

adol-awam-don-deny-di-suspension

Di gubernatorial candidate of di New Nigeria Peoples Party, NNPP, for Ebonyi State, Prophet Chris Adol-awam, on Wednesday, deny di suspension by hin Echiaba ward executive.

Remember say di leadership of NNPP Echiaba ward, led by di Secretary of di ward, Anni Okochukwu bin suspend di governorship candidate, Adol-awam over alleged anti-party activities.

But, Adol-awam wey tok through di director of media and publicity, NNPP campaign organization, Mr. Victor Uraku, blame di former chairman of di Party, Mr Solomon Chukwu for di suspension wey dem tok.

He yarn say di former NNPP State Chairman, Mr. Solomon Chukwu and hin cohort na impersonators wey falsely claim say dem suspend di gubernatorial candidate from di Party.

Also, hin yarn say hin for ignore di mischievous and malicious act but dem owe di people of Ebonyi State and teeming supporters di truth behind di lamely woven falsehood.

 

FOR MORE NEWS: “I no get manhood again, nothing dey dia” – Bobrisky don reveal

 

In addition, he claim say di bone of contention start when he (Adol-awam) asked am (Solomon Chukwu) to give a proper account.

In a swift reaction, the embattled chairman, Solomon Chukwu insist say di suspension of Adol-awam go stands. Hin claim say  Adol-awam meet secretly with di stakeholders of di ruling All Progressives Congress, APC, for Ebonyi and later accept to collapse di structure of di NNPP to di ruling party. Also, according to am, di act leave di NNPP faithfuls hopeless and frustrated for di State.

Chukwu, wey make dis matter known inside statement signed and made available to newsmen for Abakaliki, claim say Adol-awam carry out open campaign against di Presidential candidate of NNPP, Rabiu Kwankwaso in favour of di Labour Party Presidential candidate, Peter Obi, even on di presidential election day.

You fit go read di tori as Adol-awam deny di suspension…READ MORE