fbpx
May 18, 2024

“I no get manhood again, nothing dey dia” – Bobrisky don reveal

bobrisky-no-get-manhood-again

Controversial Nigerian crossdresser, Okuneye Idris Olanrewaju, wey dey popularly known as Bobrisky don shock netizens with hin claim say hin no get manhood again

Bob share one video from hin recent spa visit. For inside di video, na young woman dey use some of di spa products on top “hin” yansh.

Reacting to Bobrisky video, one Usman Olamilekan express concern about di lady. Hin tok say she fit dey look Bob ‘manhood’ as she dey do her job.

He write;

“This woman will be seeing your gbola like that oooo.”

However, inside hin response, Bobrisky make am clear say hin no get manhood again. Hin don comot and replace hin manhood with woman organ.

“There’s nothing like that there anymore. Those asking to see btw my leg zoom it 😍😍😍😍 you can only see a thick thighs with sexy shape that come with a v 🙈”, Na wetin Bob tok be dat.

 

FOR MORE NEWS: Why My ‘Colleagues’ Sleeps With Producers For Roles – Nollywood Actress Ruby Orjiakor don Open Up

 

E get di time wey Bobrisky narrate hin near-death experience after hin undergo cosmetic surgery two years ago.

Di male Barbie in 2021, claim say hin travel go di Dominican Republic for butt enlargement surgery for di first time. And hin open up say hin almost die during di procedure.

Also, e dey gathered say after di surgery, dem suppose discharge her on di fourth day but she develop some complications with her breathing.

As dat one happen, dem quickly rush her go di specialist hospital.

However, Bobrisky react via his Snapchat handle as hin share how he almost lose hin life two years ago while undergoing liposuction surgery.

You fit go read di tori…READ MORE