fbpx
November 27, 2024

African Union suspend Niger over military coup

african-union-suspend-niger-over-military-coup

Di African Union on Tuesday yarn say dem suspend Niger until civilian rule for di kontri dey restored and dem go assess di implications of any armed intervention for di troubled Sahel nation.

Also, di Peace and Security Council ask di AU Commission make dem undertake assessment of di economic, social and security implications of deploying standby force for Niger and report back to Council,” Na di bloc tok dis one, following strong differences on di matter.

Army officers overturned President Mohamed Bazoum on July 26, and dat matter make di West African regional bloc ECOWAS threaten to use force to reinstate am.

ECOWAS — the Economic Community of West African States — agreed to activate “standby force” as last resort to restore democracy for Niger.

 

FOR MORE NEWS: Premiere Academy students do well for 2023 WASSCE

 

Also, dem tok say dem don ready to act, even as dem continues to pursue hopes for diplomatic solution.

Di AU last week hold meeting on di crisis against a backdrop of divergent views within di bloc over any military intervention.

Also, di coup get international worries over di Sahel, wey dey face growing jihadist insurgencies wey dey linked to Al-Qaeda and di Islamic State group.

Niger na di fourth nation for West Africa since 2020 to suffer coup, following Burkina Faso, Guinea and Mali.

Di juntas for Burkina Faso and Mali have yarn say any ilitary intervention for dia neighbour go dey considered as “declaration of war” against dia kontries

And, di coup na di fifth for Niger history since di poor state gain independence from France in 1960.

You fit go read di tori…READ MORE