fbpx
May 19, 2024

China Advise Naija To Invest In Education, Healthcare

chinese-ambassador-advise-fg

Di Chinese Ambassador to Nigeria, Cui Jianchun, don advise di Federal Government, FG make dem invest in education, food, housing and healthcare to eradicate poverty.

Jianchun give di advice for Abuja on Monday for di unveiling of di Hausa edition of Chinese President Xi Jinping’s book, ‘Up and Out of Poverty’.

Also, hin note am say di book wey dem write in 1988, contain di thoughts of di current Chinese president on how to eradicate poverty.

 

FOR MORE NEWS: African Union suspend Niger over military coup

 

Di measures wey China take na to boost di economy. And dis na because di economy na decisive factor to eliminate poverty. Nigeria need to rely on di strength, natural resources and dem need create more jobs for its citizens.

In addition, e no too tey wey di Secretary to di Government of di Federation, George Akume, yarn say di book launch dey on point based on Nigeria mass poverty.

According to am, 80 million Nigerians live below di poverty line, especially for north.

Also, Akume wey bin dey represented by Permanent Secretary, Special Services Office, Aliyu Shinkafi, yarn say no be by chance say dem put di book together in Hausa. And dis na because Nigeria get population of 200 million, about 80 million live below di poverty line, especially di North West and North East.”

You fit go read di tori see why Chinese Ambassador advise FG…READ MORE