fbpx
June 23, 2024

Actor Chinwetalu Agu reveal why hin reject N10 million for movie role

agu-turn-down-n10-million-offer

Veteran Nollywood actor, Chinwetalu Agu don open up about hin reason why hin turn down N10 million offer.

Inside recent interview with Chude, Agu narrate how hin turn down N10 million offer from billionaire business mogul, Mike Adenuga, to play role for one movie.

According to Agu, di time wey di billionaire businessman make di offer, hin bin dey broke and hin neva make up to N1 million before but hin insist say na N20 million hin want.

 

FOR MORE NEWS: “Free Canada permanent residency” – Eko Hotel staff Ngozi who returned $70,000 go receive PR card

 

Di legendary thespian yarn say Adenuga later compromise give am di N20 million after hin threaten to waka comot.

According to Agu wey turn down N10 million offer, hin yarn say na when hin stand up to comot na hin dem see say hin serious. As di matter kon be like dat, na so Chief Mike Adenuga tell am make hin sit down, and hin order person make dem carry di documents come make hin sign.

You fit go read di tori…READ MORE