fbpx
May 18, 2024

“Free Canada permanent residency” – Eko Hotel staff Ngozi who returned $70,000 go receive PR card

ngozi-canada-resident-card

Kekwaru Ngozi Mary, one Nigerian lady wey return $70,000, dey happy, and she jump for for joy as dem promise her free Canada permanent resident card for her integrity.

Di Eko Hotel and Suites customer care share di exciting news with her fans during a recent NSSPPD service.

Kekwaaru Ngozi Mary, wey be customer care officer for Eko Hotel, start to make headlines recently after she return $70,000 wey customer forget for di suite.

Following di incident, one international organization, wey dey impressed by Ngozi display of integrity, find way connect with her as dem see say she sabi speak French.

Based on how di tori go, dem offer to help her with Canadian PR for free.

 

FOR MORE NEWS: Kate Henshaw criticize senators over holiday allowances

 

Also, dis development mark significant milestone for Ngozi life. In addition, e don open up new opportunities for her future. According to di  lady, honesty dey pay.

See wetin she tok here;

“An International Organisation called me since they know I speak French, they called me, because they want to do Canada PR for me for free.

“My local government chairman flew me down to port harcourt and lodged me in one of the biggest hotels, gave me an ambassador award and named a building after me, in my village they gave me a chieftaincy title.

You fit go read di tori see how Ngozi take get free Canada resident card …READ MORE