fbpx
May 18, 2024

Female Nigerian Airforce officer don commit suicide for Lagos

airforce-officer-don-commit-suicide

One Nigerian Airforce female Master Warrant Officer George, wey dey serve for 651 Base Services Group don commit suicide, she kpai on Sunday.

Some tori yarn say di Air Force personnel bin just dey, she no move or tok anything inside her house for Block T5 Flat 8 inside Sam Ethnan Air Force Base Ikeja, Lagos. Dis na after she hang herself inside her room around 1400hrs on 10 June 2023.

 

FOR MORE NEWS: “I have the best news” – Hilda Baci dey happy as she share big announcement weeks after cook-a-thon

 

According to di tori,  na three Air Provosts wey come with another team of personnel to carry di body go di 661 Nigerian Air Force Hospital na hin confirm di tori sayshe don kpai.

Also, di sources explain say dem no know why she kpai herself. However, dem still tok say di investigation wey dem dey do go reveal di reason for her death.

You fit go read di tori wey Airforce Officer commit suicide…READ MORE