fbpx
April 26, 2024

Adequate Amnesty Funding – Di boss dey hail Buhari

Mr-Buhari-Amnesty-Funding

Di Interim Administrator of di Presidential Amnesty Programme, Major General Barry Ndiomu (retd.), don yarn say Mr President, Major General Muhammadu Buhari (retd.), do well for di adequate Amnesty funding.

Na Ndiomu give di commendation for media conference wey dey Abuja.

Hin yarn say di current regime under Buhari don do beta job to fund PAP and dem give am sufficient resources.

Buhari no waste time finance di program and na why Ndiomu yarn say  dem fit pay stipends to di ex-agitators.

Hin yarn say dem fit even be di first government agency every month, wey fit pay stipends.

FOR MORE NEWS: Reason why Govt need to scrab EFCC – Agbakoba

One of di updates be say dem go finance di cooperatives so that dem go get access to microcredit loans. In addition, consultants wey go advise them on any kind of initiatives and businesses, entrepreneurship skills.

Hin yarn say dem fit develop business from car washing, e no matter wetin e be. Di koko be say dem go fit get money from di cooperatives wey go soon dey  establish, and na di adequate amnesty funding go make am happen.

On top that matter, dem dey think of doing fishing trolling companies.

Na this update na hin make amnesty boss hail Mr Buhari for the adequate amnesty funding.

You fit go see di full detail of this tori for Punch…READ MORE