“No dey lie say acting give you money buy house”- Angela Okorie dey blast her female colleagues
Popular actress, Angela Okorie don blast her female colleagues say make dem stop to dey pretend say na acting alone dey behind dia lavish lifestyle.
For interview with Factory 78, Angela Okorie yarn say plenty of her colleagues get other side hustles to fund dia lifestyle.
According to her, di only reason why actresses dey more successful than dia male colleagues na because dem get other source of income.
Also, She mention how upcoming actresses, wey neva even last one year for di industry dey flaunt mansions. And dem dey always give credit to di industry for dia expensive possessions.
Angela Okorie blast her female colleagues say that kain act dey make di pipo wey dey di industry for years look unserious.
She stress di fact say nobody fit tell her say na act alone dey behind such lifestyle. This na because she follow dey di field and na for years now.
Also, she yarn say person go see somebody wey just enter Nollywood, di person neva even last for a year, but dem go dey blow lie give pipo say dem buy house.
To conclude and address di matter, she tell them say if e get something wey dem dey do to warn money, make dem tok am.