fbpx
September 29, 2024

APC dey accuse Adeleke say hin sponsor protests, PDP don react

apc-yarn-say-adeleke-sponsor-protests

Osun State chapter of di All Progressives Congress APC on Sunday yarn say PDP sponsor di protests for di state against di judgment of di state Election Petition Tribunal wey sack di state Governor, Senator Ademola Adeleke, on Friday.

Di party yarn say na Adeleke and hin party, di Peoples Democratic Party na hin sponsor am. APC tell PDP say that kain thing go only make dia case worst and e no go add anything positive to them.

However, di Osun PDP acting chairman, Dr  Akindele Adekunle don react to di matter. Hin tell APC say no be Adeleke sponsor di protests. But di protest show say di pipo no agree with di verdict of di panel.

For August 2022, di immediate past governor of di state, Gboyega Oyetola, and di APC for di tribunal challenge di victory of  Adeleke, di PDP governorship candidate. E happen during di July 16, 2022 governorship poll for di state.

FOR MORE NEWS: APC don commend Emefiele on extension of naira swap deadline

Although Na two out of di three-member panel of di tribunal deliver di judgment. Dem yarn say Oyetola prove say over-voting bin dey for some of di polling units.

Tetsea Kume, wey read di majority decision, yarn say INEC no comply with di constitution and di provisions of di Electoral Act.

On Saturday,  protests bin happen for Osogbo. PDP supporters bin enter street fo di state capital, and dem yarn say tribunal no judge well.

Plenty business owners for di city no open because of fear of being attacked by hoodlums as every thing dey like this.

Di PDP protesters march through Osogbo, and dem dey chant songs. Dem no agree with tribunal judgement.

Na this protest now na hin make APC cause PDP say na dem sponsor am

You fit go read di full tori…READ MORE