fbpx
May 18, 2024

New naira: Pipo anger don increase scarcity, Reps dey oppose CBN extension

new-naira-cbn-extension-reps-dey-oppose-CBN-

Di House of Representatives don reject di February 10 deadline for di phasing out of old currency notes wey CBN Central Bank of Nigeria announce on Sunday. According to di House of Representatives Ad hoc Committee on New Naira Re-design and Naira Swap Policy on Sunday, dem describe di extension as a mere political trick. Hin yarn say dem wan use that one deceive Nigerians and to worsen dia economic and social livelihood.

As this development come, anger don full everybody heart for di Country. In addition, bank customer just dey stranded as dem no see new naira note collect. Pipo wey dey sell thing follow dey reject di old note. Upon all these things, na long queue pipo still dey see for ATM galleries across di country.

FOR MORE NEWS: APC don commend Emefiele on extension of naira swap deadline

However, as CBN Governor, Godwin Emefiele announce di new deadline for phasing out of di old N1,000, N500 and N200 notes on Sunday, hin yarn say di President, Major General Muhammadu Buhari (retd.), give am di permission to extend di deadline to February 10 after hin recent meeting with am.

On top this extension, CBN add extra seven days so that Nigerians go fit deposit dia old naira notes, then  new naira not go take over from February 10.

Although di date wey CBN fix before na as di deadline for di exchange of old N1,000, N500 and N200 notes na January 31.

You fit go read di full tori…READ MORE