fbpx
December 22, 2024

Why marriages no dey last these days – Apostle Johnson Suleman

Apostle-Suleman-reason-on-failed-marriages

Di general overseer of Omega Fire Ministries, Apostle Johnson Suleman don share di reason on why most marriages dey fail and why e no dey last.

Apostle Johnson Suleman explain why di marriages of these days dey always fail compared to di marriages of di past.

As hin dey preach sermon for hin church, di man of God reveal say  marriages dey fail because of di excessive use of social media platforms.

According to Apostle Suleman, most youths depend on pieces of advice wey dem get from social media and wetin dem see online to manage dia marriages.

 

FOR MORE NEWS: Kwara Poly Withdraw Student Certificate Over Cultism

 

In addition, he yarn say dem don completely ignore di advice from dia elderly ones.

Apostle Johnson Suleman yrn say for olden days, before woman or a man married enter family, di two families go do proper investigations to confirm which family dia pikin wan marry enter. But now because of plenty changes, most of these acts dey ignored by di youth.

He add say most marriages no dey last again because no further checks dey happen before di institution of marriage between parties.

You fit go read di tori as Apostle Suleman share reason on why marriages fail..READ MORE