fbpx
May 15, 2024

Arewa youths condemn increase in fuel pump price

Arewa-Youth-condemn-petrol-increase

Di Arewa Youth Forum, AYF, don condemn in strong terms di increase in pump price of Premium Motor Spirit, PMS, popularly known as petrol.

Inside statement issued by di National President, Ahmed Mohammed Zagi, di group yarn say dem received with shock di increase in price of petrol to over N600.

Also, di youths note di N8,000 monthly stipend to some families for di Kontri, although dem feel say an upward review dey necessary because of di way wey di cost of goods and services for di kontri dey increase.

 

FOR MORE NEWS: Fuel price: NLC, NUJ, dey vex as frustration spread nationwide

 

So, dem appeal to federal government make dem inspire states to prioritise agricultural revolution. Dis na to make sure say enough food dey for di Kontri. Also, dem believe say di efforts go lead to di crashing of prices of food products through di natural law of demand and supply. Di way were things dey increase, e follow add to di hardship wey pipo dey face.

Di youths also appeal to President Tinubu and hin advisers to think harder and come up with lasting solutions to di economic misfortunes of di Kontri.

You fit go read di tori see why Arewa Youth follow condemn petrol increase…READ MORE