Ashymushy affair with Dino Melaye: “Na Strategy To drive attention” – Ashmusy
Amarachi Amusi, aka Ashymushy, don deny di allegation wey dey trend about her inside this week. Pipo yarn say she and another skit maker, Nons Miraj, get affair with controversial politician, Dino Melaye. This issue of Ashymushy affair with Dino Melaye don make her tok wetin dey her mind for interview.
During di interview with Saturday Beats, Ashymushy yarn say na her hard work dey fund her luxurious lifestyle. She tok am ask response to di allegation.
She tok say she go tell pipo wey dey accuse her say make dem continue to swim for dia ignorance and poverty; na dia problem.
FOR MORE NEWS: Omori charge Portable $50,000 for music video – “Na ritualist you dey shoot video for?”
Ashymushy yarn say if pipo no fit see di work wey dem dey do, and di things wey dem dey post every day, and if dem no fit know say na wetin dey bring money for her, na dia problem. Na for there he deny di allegation wey tok say na person dey give her money.
Acoording to her, di matter bin shock her when she see di new for Internet during the week. She still yarn say she neva see Dino Melaye before talkless of to get something with am.
Ashymushy affair with Dino Melaye na just strategy wey di blog wey dey involved dey try use clout and drive attention to dia page.
She tok say she and di blogger dey always chat about business, so as she see di tori, she send a message to di blogger say why dem for post something wey dem neva verify.
Di blog dey anonymous, and that is why dem get mind post am, according to her. Meanwhile, Ashmusy say she dey moving on to more important things for her life.
You fit go read di full tori…READ MORE