fbpx
September 30, 2024

“Ashewo Too Dey This Babe Eyes” – Reactions As Ayra Starr Backside Pop Out From Skimpy Outfit During Stage Performance

Ayra-starr-outfit-don-cause-reactins-online-

No be news again say di fast-rising songstress, Oyinkansola Sarah Aderibigbe, wey dey known as Ayra Starr dey always make pipo dey tok because of di racy outfit wey she dey always wear.

Di ‘Rush’ hit maker again don cause reactions from social media users because of di kain show body outfit wey she wear during her stage performance.

Ayra Starr wey perform before di crowd dey spotted as she wear hoodie wey no even reach her waist and she wear pant for di lower part of her body.

As she dey perform, na so small part of her ynash come out of di pants especially when she bend.

However, di video don spark mixed reactions from IG users; some yarn say di singer no do well with her choice of outfit, others still compliment her look.

FOR MORE NEWS: “Hin Story Don Change” Cubana Chief Priest Don Vow To Make Di Teenager Millionaire As Hin Stand In Front Of Peter Obi Convoy

See di reactions from IG users below:

One virginpole write: “Diday dem go shook hand for her Towtow make she no cry justice for me o”

adeola_shantel write: “Na tiwa savage pikin😂”

djbey444 write: “I think it’s showing a bit much auntie 😩😔”

osidorz write: “She for just naked go”

randii_spice write: “Di small ynash no bad sha😍”

jayson_famous write: “Ashewo too Dey this my babe eye”

django.ace write: “This girl no go Dey baff😂”

forbeswhite1 wrote: “So beautiful”

vixny_nyovest wrote: “Oversability dey kili person 😂😂😂

You fit go read di full tori…READ MORE