fbpx
December 22, 2024

Bandits kill 120-year-old woman and 5 others for Sokoto Bandit don attack

0
Bandits--1024x581.jpg

Bandit don attack Raka village of Tangaza Local Government Area for Sokoto State and don burn down many houses and carry food items run comot.

According to tori, report tok say one 120-year-old woman and five other community members don kpai for dis incident.

U FIT ALSO READ Why I dey bath with blood, 49-year-old man tell Ogun Police

Di district head of the area, Alhaji Sa’idu Wakili confirm di attack, give tori pipol say dem no kidnap anybody, but dey burnt down two to three houses and food items.

Hin tok say hin dey beg federal and state governments to put more effort in solving di security challenges for di area.

Di district head don also call on rich pipol for di area to try formulate all means of protecting di lives and properties of di pipol for di area.

Di acting chairmo of Tangaza Local Government Council, Alhaji Ibrahim Lawal Junju, accompanied by di Special Adviser to di Governor on Roads Maintenance, Engr. Mai Damma Tangaza. dey both visit di community and also sympathize with di villagers and dey don also promise to findings to di necessary assistance to di victims.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *