fbpx
May 19, 2024

Algeria don show interest to host 2025 AFCON

0

Algeria don show interest to host 2025 Africa Cup of Nations, di football federation yarn dis one on Friday after Guinea wey suppose host di tournament don come out tok say dem no go fit host am base on say dey never put di necessary infrastructure in place.

Algerian Football Federation spokesman Salah Bey Aboud tok say “ hin dey for Cairo like dis and hin don officially submit Algeria’s application” to host di tournament for 2025, na wetin hin tell public radio station Chaine 3 bi dat.

U FIT ALSO READ EPL: Selling Manchester United na di best way to go – Ten Hag

Cairo-based Confederation of African Football don come out tok say dey don receive bid from both Algeria, Morocco, Nigeria and Benin on who go host di next African cup of Nations

Algeria sport and youth minister on Tuesday tok say di country application to host di 2025 African cup of nations don dey “solid and consistent”

Unlike other bids, Algeria get enough facilities wey dey standby and readi for use. Na wetin Abderezzak Sebgag yarn APS official news agency bi dat.

H8n tok say Algeria don dey tok dis thing bifore. since early October, say dem dey readi to host di AFCON, immediately after Guinea’s President Patrice Motsepe tok say di countri no get power to host am again.

CAF don tok say dem go inspect all di whole facilities for January bifore dem go con decide on who go host di  tournament for 2025.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *