fbpx
December 23, 2024

Bank Directors don Intervene for Naira Notes Scarcity wahala

bank-directors-intervene-for-naira-notes-wahala

Directors of banks, under di Bank Directors Association of Nigeria (BDAN) yarn say dem dey work to free up di bottlenecks wey lead to di unavailability of Naira notes for di country.

This na even as dem show pity for bank customers wey no fit make cash withdrawals across di country.

For inside statement signed by di group chairman, Mustafa Chike-Obi, BDAN yarn say dem dey communicate with banks and dem dey find ways to bring di situation under control.

FOR MORE NEWS: Netflix don extend crackdown on password sharing to more countries

Also, di bank directors tok say dem dey mindful of di discomfort and hardship wey dey associated with di current currency reform wey itroduce di newly designed naira notes and reduction in withdrawal limit.

Although, hin confirm say indeed, this na difficult period for Nigerians, but BDAN dey make am dia top priority to ensure say this hardship stop. In addition, dem dem in constant communication with all di Banks and dem give assurance say banks dey do everything within dia control to normalise this difficult situation.

In conclusion, di group point out say make di banking public maintain peace, because BDAN dey take all reasonable steps to influence di structure and mechanisms wey go free up bottlenecks and open channels wey go speed up di resolution of di crisis.

You fit go read di full tori…READ MORE