fbpx
April 29, 2024

Kogi guber: Gov Bello, SDP candidate, Ajaka in tough battle

battle-between-ajaka-and-bello

Di political battle between di Kogi State Governor, Yahaya Bello and di Social Democratic Party, SDP, candidate, Alhaji Muritala Yakubu Ajaka don take new twist as di electorates dey prepare for di November 11 governorship election.

Dis na election, wey dey less than 150 days away, and e don dey generate tension already.

According to report, Governor Bello and Ajaka be political allies before.

One of di major critics of Governor Bello na di governorship candidate of di People Democratic Party, PDP, Senator Dino Melaye.

Since Senator Melaye fall out of romance with Governor Bello during hin first tenure, hin seized every opportunity to criticise hin administration.

 

FOR MORE NEWS: “Anarchy no go dey if court remove you” – LP react to President Tinubu statement

 

You go fit remember say di former Kogi lawmaker for one of hin comments ‘prophesy’ say after Governor Bello tenure, hin see am (Bello) dey wear prison uniform.

With di exception of Melaye, plenty opposing political players before now no tok anything on Bello administration.

But since di outcome of di 2023 APC governorship primary, e appears say di pendulum don shift from Melaye of di PDP to the governorship candidate of SDP, Ajaka, wey happens to be a former Deputy National Publicity Secretary of di ruling All Progressives Congress, APC.

You fit go read di tori of di political battle between Ajaka and Bello…READ MORE