fbpx
December 22, 2024

We don lose 130 Persons In 10 Days – Ortom

benue-lose-130-persons-in-ten-days

Benue State governor, Samuel Ortom don reveal say dem don lose over 130 persons wey don die for di hands of suspected armed herdsmen across di state in ten days

Di governor, wey disclose dia matter after security meeting for Makurdi also announce di suspension of di operation of livestock guards wey get plenty responsibility of arresting stray animals for two weeks.

He yarn say di decision to suspend di operation of livestock guards na to enable di herdsmen make dem go back where dem come from.

FOR MORE NEWS: Jubilation as Don Jazzy bless Twitter user with N1M for accommodation

As hin dey lament about di allege involvement of some young persons for Benue wey dey work with armed herdsmen to rustle cattle and sell dem, di governor also allege say some traditional rulers and stakeholders for some affected communities no dey exempted from di unholy act even as he direct di security agencies to arrest any body wey dey found guilty no matter how highly placed

Also, hin give warning to di pipo wey dey work with di armed herdsmen to rustle cattle. Hin condemn di act and he advise dem make dem stop dat unholy act because hin don directe security agencies to arrest anyone found wanting, irrespective of status, tribe, religion and affiliation.

You fit go read di tori as Benue lose 130 persons…READ MORE