fbpx
May 18, 2024

Jubilation as Don Jazzy bless Twitter user with N1M for accommodation

don-jazzy-send-fan-n1m

Music executive, Don Jazzy don put smile on di face of one Twitter user and fan after he send am N1M for accommodation.

Michael Collins Ajereh, wey dey better known as Don Jazzy, follow dey known to occasionally give to hin fans wey dey in need. Yesterday, one Twitter user and fan get luck, after Don Jazzy send am di sum, of N1M.

FOR MORE NEWS: “I love my people, but Nigeria na very corrupt place” – Israel Adesanya

Di user write:

“@DONIJAZZA baba plz i need accomodation, we’re living in a kiosk, because we financial problems. But the midnight weather is affecting my baby seriously. Hope I didn’t ask for too much Sir. I will be glad to hear from you u DONJAZZY “

In a shocking remark, Don Jazzy reply, hin tok say hin dey sorry about hin predicament, and say hin don send am N1M.

Don Jazzy follow send another Twitter user N250K to buy Canon camera for hin business.

You fit go read di tori…READ MORE