fbpx
June 26, 2024

“Last Last Grammy Don Give Burna Boy Breakfast” – Nigerians Don React After Burna Boy Lose Two Categories For Di Grammys

burna-boy-lose-grammys

Nigerians wey dey Twitter don react after Burna Boy lose for two categories for di 2023 Grammys.

Di Nigerian singer don fix two nods for hin album, Love Damini under di category of Best Global Music Album as well as “Last Last” for Best Global Performance.

South Africa Wouter Kellerman, Zakes Bantwini & Nomcebo Zikode defeat Burna Boy Last Last to claim di award for di Best Global Music performance.

Also, Burna Boy album Love Damini follow lose di best Global Music Album award to Japan Masa Takumi for di Grammys.

Dem hold di 2023 Grammy Awards ceremony for di Arena wey dey Los Angeles.

See Nigerians reaction below….

@Lirahagain write

As Burna boy and Angelique kidjo no win, who Burna wan run go meet?

@_theladymo write

Last last na anthem sha, dem rob burna boy

@franklysundiler wrote

Burna boy bin yarn say hin musical mother angelique kidjo bin tell am everything wey hin need to know about di Grammys. Music mother and son lose last night 😭😭, Odugwu bottle two 😂 Grammy na your mate 😭😂

@djjism wrote

Burna Boy lost two Grammys? If you like go hin next show dey press phone 👍🏾

@KodyPlug wrote

We know as you Dey run am. Always back stronger and better

@_smithdc wrote

Wait, So burna boy no collect Grammy 😂😭