fbpx
December 23, 2024

Cash crunch dey affect Ramadan, Islamic body tell FG

cash-crunch-dey-affect-ramadan

Di Jama’atu Izalatul Bid’ah Wa Iqamatus Sunnah for Bauchi State, on Friday, appeal to di Federal Government say make dem allow naira notes dey available during di Ramadan because di cash crunch dey affect dem.

Also, di Chairman, Tafsir Committee Kasuwan Shanu JIBWS mosque, Alhaji Hassan Gwani, make di appeal during di opening of dis year annual Ramadan tafsir.

According to am, Ramadan don come again and di currency wey dem suppose use for daily purchases no dey available and because of cash crunch wey dey affect dem,  and dat one don make di situation hard for pipo to buy wetin dem need.

Also, hin yarn say if di FG want make pipo receive di policy with open arms and successful, di new naira notes need to dey available for people to spend.

FOR MORE NEWS: “Atiku, Obi dey behind di false report of Tinubu, Ariwoola secret London meeting” – Fani-Kayode

Meanwhile, di Federal Executive Council don congratulate di Muslim faithful as dem start di month-long Ramadan fast.

Di Secretary to di Government of di Federation, Mr Boss Mustapha, convey di congratulatory message on behalf of FEC on Friday, inside statement issued by di Director of Information, Office of di SGF, Mr Willie Bassey.

For Jigawa State, di government don reduce di official working hoursfor di state by two hours during di period of Ramadan.

Di state Head of di Civil Service, Hussaini Kila, reveal dis tori inside statement issued to journalists by hin Public Relations Officer, Ismail Dutse.
You fit go read di tori…READ MORE