fbpx
April 26, 2024

“No wash or cook for your boyfriend, I no do am for my man, yet he marry me” – Christabel Egbenya dey warn ladies

no-wash-or-cook-for-boyfriend-Christabel-Egbenya-criticize-girls

Nollywood actress, Christabel Egbenya don criticize young girls wey dey cook, wash and do all sorts for dia boyfriends so dat dem go fit  convince di men say dem ready for marriage.

Di newly married mother of one make dis matter known in reaction to viral video of one girl wey invest all of her saving for her boyfriend wey run comot with another lover to overseas.

FOR MORE NEWS: “Atiku, Obi dey behind di false report of Tinubu, Ariwoola secret London meeting” – Fani-Kayode

According to Christabel Egbenya as she dey criticize young girls, she yarn say if dem give man money, dat one no go make di man marry dem. Also, she warn di ones wey dey spend days for dia man house dey was, clean and do all sorts of erotic things on bed.

She yarn say tomorrow when di man dump dem for another person, dem go start to dey cry and complain.

In addition, she yarn say why di man no go dump dem? When do girls don offer di man all di things wey dem get so tey nothing remain.

“Stop to dey do wife when di man neva go pay your bride price. “ Na wetin she tok be dat.

You fit go read di tori…READ MORE