fbpx
March 29, 2024

Chinese man don kill 23-year-old Nigerian lover for Kano

0
Chinese-man-kill-lover

One Chinese man wey dem identify as Geng Quangrong allegedly use knife stab hin lover to death. Di lover na 23-year-old woman, Ummu Kulthum and di Chinese man kill her for Janbulo quarters, Kumbotso Local Government Area of Kano.

Di police for Kano confirm wetin happen hin spokesman SP Abdullahi Haruna Kiyawa, wey explain say di suspect, Geng, 47, commit di crime on Friday after he climb di fence of di deceased house to take enter her house, na there he stab her plenty  times until she die.

YOU FIT STILL LIKE THIS ONE: NDLEA block 26,600 bottles of ‘Akuskura’ for Kano, dem arrest di producers.

Geng alleged say  Ummu wey be hin girlfriend deceive am after she don promise to marry am. he yarn say she betray am even after he spend plenty money for her.

The suspect talk say di thing wey make am vex na because of how she take deceive am. Na why hin to attack di decease for her house.

You fit CLICK HERE read di tori.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *