fbpx
May 18, 2024

No Set Nigeria on fire, deliver good judgment – COSEYL call on Presidential Elections Tribunal

coseyl-call-on-elections-tribunal

Di Coalition of South East Youth Leaders, COSEYL, don call on di Presidential Elections Tribunal to deliver good judgment on di petitions filed by opposition parties. Dem add say wrong judgment fit set di entire nation on fire.

Dis call follow di commencement of di hearing of di petitions filed by di Labour Party presidential candidate, Peter Obi, and hin Peoples Democratic Party, PDP, counterpart, Atiku Abubakar, wey dey challenge di victory of President-elect Bola Tinubu.

Di tribunal, wey commence di pre-hearing on Monday, adjourn am to Wednesday, May 10.

 

FOR MORE NEWS: NECO don reschedule national entrance examination, dem reveal new date

 

Warning against compromise during di hearing, COSEYL, inside statement by di President-General, Goodluck Ibem, tok say di court decision go affect all Nigerians either positively or negatively.

Also, hin yarn say di judges need to consider di fact say di judgement wey dem deliver go either affect them positively or negatively.

In addition, hin yarn say make dem tread di path of truth and fairness in order not to put the nation on fire.

“Injustice to one na injustice to all.

All of dem dey pray for di judges and dem advise all Nigerians make dem pray for dem so dat dem go get Solomon order of wisdom to deliver judgement.

You fit go read di tori as COSEYL call on Presidential Elections Tribunal…READ MORE