fbpx
November 15, 2024

Court don sentence Enugu couple to 13 years in prison for child abuse.

0
Couple-Child-abuse

High Court for Enugu state don sentence staff of di Central Bank of Nigeria, Jude Ozuogu, and hin wife, Ifeoma, to 13-years imprisonment for child abuse.

Na state police command arrest di couple  for July 2020 because dem physically assault and maltreat dia 10-year-old househelp, Nneoma Nnadi, for dia house wey dey Aku for di Igbo-Etiti Local government area of di state.

FOR MORE NEWS: Why I dey bath with blood, 49-year-old man tell Ogun Police

Neighbors wey lodge di complaint against di couple yarn say di pikin suffer serious torture because she make dia baby fall for ground.

From di tori, Nnandi carry her madam baby dey pet her so that she go sleep for midnight, na so di baby mistakenly fall for ground

But di baby no suffer any physical or internal injury, di couple no look that one, dem pounce on di maid, burn her skin with a hot pressing iron.

Dem still drill nail inside her head, put pepper for her vagina, kon lock her up inside toilet because she no wash plates.

You go like go read di full tori…READ MORE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *