fbpx
December 23, 2024

BREAKING: Court don grant ex-CBN gov, Emefiele N20m bail

court-grant-emefiele-bail

A Federal High Court sitting for Lagos on Tuesday grant di immediate past Governor of di Central Bank of Nigeria, CBN, Godwin Emefiele bail.

Di court grant Emefiele bail in di sum of N20 million and a surety in like sum.

Also, dis matter follow a two-count charge of illegal possession of firearm wey dey levelled against am by di Department of State Service, DSS.

Emefiele lawyer, Joseph Daudu bin apply for bail after hin client plead not guilty to di two-count charge, hin contend say di offense for which Emefiele dey charged dey bailable.

 

FOR MORE NEWS: Court grant group permission to observe Emefiele trial

 

Di DSS pick up Emefiele about a month ago after President Bola Tinubu suspend am.

Also, dem carry am go court in white Toyota Hilux pick-up van, with di plate number covered, around 9:23 a.m.

On arrival for court, Emefiele come down from di van and hin bin dey assisted by one female before Justice Nicolas Oweibo.

You fit go read di tori…READ MORE