fbpx
May 9, 2024

Obama family private chef drown

obama-family-private-chef-drown

Local authorities don confirm say Tafari Campbell, di private chef of di family of former United States President Barack Obama drown over di weekend.

Di body of di 45-year-old Campbell, wey go missing over di weekend for Martha’s Vineyard bin dey recovered from Edgartown Great Pond by Massachusetts State Police.

According to USA Today, di police yarn say dem see di body for inside di pond some minutes before 10 am Monday, as di recovery happen about 100 feet from shore.

Massachusetts Environmental police officers initially conducted a side scan-sonar from a boat to figure out where Campbell’s body was located.

Di report yarn say di emergency responders bin go one property wey belong to Obama for reports of drowning at around 7:46 p.m. Sunday, dis na wetin di police said.

 

FOR MORE NEWS: Court grant group permission to observe Emefiele trial

 

According to wetin one fellow paddleboarder report, hin yarn say di man no resurface.

Police Yarn say Campbell bin dey paddleboard near di Obama residence when hin fall off di board without life jacket and na so hin drown.

Before death, according to di Associated Press reported, di former president and first lady Michelle Obama tok inside statement say Campbell na“beloved part of dia family.

She narrate how hin be talented sous chef for di White Hous when dem first meet am. Also, she tok say hin dey creative and passionate about food, and hin ability to bring people together.

In di years wey follow, dem kon know am as warm, fun, extraordinarily kind person wey made all of dia lives bright.

Campbell don stay with di Obama family since dem comot for di White House in 2017.

You fit go read di tori as Obama family private chef drown…READ MORE