fbpx
April 26, 2024

Court don reinstate Ademola Adeleke as Governor of Osun State

court-reinstate-ademola-adeleke

Di appellate court wey dey for Abuja don reinstate Mr Ademola Adeleke as the governor of Osun State.

Remember say di Osun State tribunal bin sack Adeleke as Governor months after hin victory because of matter wey dem call over-voting for 749 polling units inside di 10 LG areas of di state.

A three-member panel of justices decide for Adeleke appeal on Friday, and dem conclude say di election tribunal fall short to find out Gboyega Oyetola and di All Progressives Congress claim of over voting.

FOR MORE NEWS: “Alex Otti go prove to Nigerians say Labour Party na great party” — GRV

Di court of appeal don fault di tribunal for making decision based on oral witness of allege over voting as wetin dem consider as di information for di BVAs and voter registration.

In addition to overturning the tribunal decision, di court give di All Progressive Congress, APC, and dia candidate Gboyega Oyetola N500, 000 in costs in its lead judgment, wey dey delivered by Justice Mohammed Lawal.

You fit go read di tori of di Court wey reinstate Ademola Adeleke…READ MORE