fbpx
December 23, 2024

“Having money helps. No let anybody lie give you” – DJ Cuppy

cuppy-say-money-make-life-easy

Nigerian disc jockey and singer, DJ Cuppy, yarn say to get money dey make life easy.

Di billionaire daughter, wey dey on vacation for di Maldives, enter her social media page to share her opinion.

According to her, she like to travel because e involve taking time to rest wey dey essential.

Also, she yarn to travel dey always remind her of how important person need to take care of dia sef. And, she tok say if person get money dem go feel relaxed.

“Travel reminds me how important self-love is. Taking time for rest is essential, and there’s nothing like the feeling of being surrounded by inspiration”

 

FOR MORE NEWS: Trouble as Wande Coal no gree put Davido Song For Hin Forthcoming Album

 

“In short….having money helps for sure. Don’t let anyone lie to you,” Na wetin she tok be dat.

Dis update dey come after di disc jockey for interview reveal say she and Ryan engage just two days after dem meet for di first time.

She yarn say di engagement bin dey fast, so dem bin no know much about dia sef until after di engagement.

“I got engaged in November. Yes. After two days. Wow. He was like in Dubai, so I was like So where do you live? You get to know the person after. Yes. Because it was so quick.” She said.