fbpx
September 29, 2024

Serious Fight Break Out For ATM Point Over Customer Attempt to Withdraw Cash With Plenty Cards

Customer-Fight-for- ATM-Point

Na serious fight happen for di ATM point of a tier-1 bank on Friday, January 27, 2023, over disagreements about weda customer fit use plenty cards withdraw cash from di ATM at at once. According report from pipo wey bin dey di scene, di fight for di Access Bank branch wey dey for Ago Place Way, Okota, Lagos, start when some customers tok say dem must withdraw cash with 4-5 cards when e reach dia turn.

Since di Central Bank of Nigeria don give order say di maximum withdrawal for any individual card na N20,000 daily, e make sense for pipo wey need more cash to withdraw with different card.

Although di act bin dey clearly rejected by other customers wey insist say make each person use maximum of two cards for withdrawal.

Na for di queues person bring di suggestion so that e go move fast and everybody go fit get at least a maximum of N20,000 of di currency wey dey scarce already. However, di no pipo wey wan use all dia cards at once no gree accept di suggestion. Dem no even consider others, na wetin kon make di customers fight for that ATM point.

FOR MORE NEWS: South African Police Officers Under Arrest For Beating Nigerian To Coma

As dem continue to dey argue, na so dem start to dey push dia sef, before person know wetin dey happen, di matter do already go out of hand. Di pipo wey deey fight start to dey carry something dey hit dia sef. E get wey e reach, other customers kon finally separate dem.

Private security officers and di police for di bank bar customers from using di ATM for close to an hour until normalcy and orderliness dey restored. Na di fight for d ATM point na hin force dem make di decision.

 

You fit go read di full tori…READ MORE