fbpx
May 18, 2024

Death of SS3 student for Akwa Ibom school spark controversy

death-of-student-for-akwa-ibom

Di mysterious death of one Senior Secondary School 3 student for Akwa Ibom State don become object of controversy.

According to reports, di deceased, Edima Ini Umoh, until her death na student of Full Life Academy, Uyo, Akwa Ibom.

Di matter start as a minor complaint for headache but within di next few hours, Edima no dey again.

Her death now don spark allegations against di school authority.

But di school management on dia part yarn say di mother of di deceased get plenty questions to answer.

According to di Principal, Full Life Academy, Pastor Aniefonteabasi Victor- Williams, everything happen fast as nobody know wetin cause her death.

 

FOR MORE NEWS: “Late Murphy Afolabi dey owe me N1.4M” – Woman reveal during Fidau prayer

 

She yarn say di deceased student complain of headache in di morning of dat fateful day and the nurse give her paracetamol. Also, di girl add say she feel better and she join her mates for lunch at about 2:30 pm, she even demand for extra food.

However, di Principal tok say at about 4:00 pm of same day, Edima complain of headache again, at dat point the school nurse bin wan start malaria treatment so dat di headache no go turn to full blown fever.

So, she bring Coartem- an antimalarial drug to administer give di her but di deceased no gree take am, instead she yarn say make dem inform her mother make she buy Amathem for her.”

She explain say at that point, di school matron call Edima mama and she give her di phone to speak with her mama.

Di tori plenty for ground.

However, di family no ready to buy into di narrative by di school management.

You fit go read di full tori of di Death of student for Akwa Ibom state…READ MORE