Deby Oscar raise alarm as her sister abusive ex-husband ready to remarry for di 3rd time
Popular actress Deby Oscar don raise alarm about di abusive ex-husband of her sister, wey don ready to wed another woman for di third time.
Inside recent post on top her Instagram page, Deby Oscar share picture of di accused abuser and hin soon to be wife. Also, she hope say hin no go treat hin new bride di same way wey hin treat her sister.
She yarn say in order to warn di new lady about di kind of man wey hin be, na why she make di decision to raise concern over di upcoming marriage.
Di actress beg pipo wey fit know di woman say make dem tell her make she no go through with di marriage.
FOR MORE NEWS: Speed Darlington spark outrage as hin launch search for girlfriend between 16 to 20 years
As she post di man pre-wedding picture with hin bride to be, Deby write:
“I’m the woman that will speak ohh. I will talk!
We let abusive men get away with it and someone else’s child will suffer it!
Because if the first wife had summoned the courage to warn my sister and make her presence known she would NEVER have married him.
You fit go read di full gist see why Deby Oscar dey raise alarm…READ MORE