fbpx
April 24, 2024

Despite PDP crisis 2023, We go shock Nigerians – Saraki

0

Former President of di Senate, Dr Bukola Saraki of di Peoples Democratic Party, PDP,don come out tell Nigerians say PDP go shock everybody in di forthcoming 2023 general elections, regardless of any crisis wen dey happun.

Saraki yarn tori pipol shortly after di 10th memorial anniversary prayer in memory of hin late father, Dr Abubakar Olusola Saraki, for Ilorin Central Jumat Mosque on Monday.

U FIT ALSO READ Buhari dey weak in managing Nigeria economy, governance – Report

Hin tok say di political crisis between Atiku Abubakar and G-5 governors led bi Rivers State Governor Nyesom Wike would be solved very soon.

Di former two-term governor of Kwara state tok say “PDP go surprise Nigerians.
PDP don readi to work together to beta di life of many Nigerians.dis is becose di party dey think about wetin go good for di countri.

“since Nigerians want PDP back in power dem self don readi to put Nigerians às dia first priority.

Saraki tok say“di time wen hin papa dey convince am to go into politics e no dey easy at all. In fact, it was a battle, I resist.
But today, hin con see say di greatest satisfaction for dis life na to see pipol progress for wetin dem dey do.

Dignitaries at the memorial prayer included Minister of State, Mine and Steel Development, Senator Gbemisola Saraki, ex-Kwara State governor Abdulfatah Ahmed, former PDP national chair, Abubakar Kawu Baraje and former Youth and Sports Minister Bolaji Abdullahi.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *