fbpx
December 23, 2024

Diphtheria warning alert to Nigerians – NCDC don sound alarm about di disease outbreak

diphtheria-warning-alert-to-nigerians-comfirmed-cass-dey-some-states-for-Nigeria

Diphtheria warning alert to Nigerians

Di Nigeria Centre for Disease Control and Prevention don sound alarm of di Diphtheria warning alert to Nigerians. NCDC yarn say yarn say dem respond to reports of diphtheria cases for Lagos and Kano states.
As di matter be now, dem dey monitor di situation for Osun and Yobe States where dem dey pick up cases.
 NCDC open up about this matter for public health advisory wey dia Director General, Dr. Ifedayo Adetifa sign. Na on Friday dem issue di statement about di outbreak of di disease for di country.
Di agency tok say dem confirm some cases, and dem dey work with state ministries of health and partners to make sure dem give better response to di outbreak.
This Diphtheria warning alert to Nigerians dey important. Di disease na serious bacterial infection caused by di bacterium called Corynebacterium species. Na di nose, throat, and sometimes, person skin na hin di disease dey affect.

 

“Diphtheria dey spreads fast between people through direct contact with infected people. Pipo fit contact am from droplets of cough, sneezing,  and contact with contaminated cloth and objects.”

“Di signs and symptoms dey starts after two to 10 days of exposure to di bacteria. Symptoms of diphtheria na fever, runny nose, sore throat, cough, red eyes (conjunctivitis), and neck swelling.
NCDC follow advise healthcare workers make dem maintain a high index of suspicion for diphtheria. Pipo wey get di disease need to isolate themselves and notify di local government area, state disease surveillance officer, or di NCDC.
You fit go read di full  tori…READ MORE