fbpx
May 18, 2024

DSS get power to prosecute cyberstalking – Judge don rule

dss-get-power-to-prosecute

Federal High Court wey dey for Yenagoa, Bayelsa State, on Friday dismiss di preliminary objection wey dey filed by defence counsel. Di objection dey challenge di prosecution power of di Department of State Security (DSS) to prosecute cybercrime. However, di court don rule say DSS get power to prosecute.

On October 18, 2021, di DSS prosecute one teenager before court on a charge of cyberstalking.

Di defendant, according to di prosecution, allegedly engage in cyberstalking by circulating di nude picture of one retired Permanent Secretary on top social media after she tried to blackmail di retiree to paying her N15 million.

Counsel to di teenage girl, Mr Andrew Arthur, bin file Notice of Objection challenging di powers of DSS to investigate and prosecute di charge wey dey filed against di defendant.

 

FOR MORE NEWS: Olumba Olumba don carry evangelism to Ekiti

 

 

Delivering a ruling, Justice Isa Dashen yarn say hin don carefully consider di submission of di arguments on both sides and di cases wey dem bring. Also, hin tok say hin understand them. In  addition, hin yarn say he disagree with di defence wey tok say DSS no get power to prosecute cybercrimes.

Also, hin tok say Under di Cybercrimes Prevention and Prohibition Act 2015, di DSS na relevant security Agency and dem get di competence to investigate and prosecute cybercrimes.

Justice Dashen yarn say di DSS fit investigate di case and dem DSS get power to prosecute, also hin dismiss di Notice of Preliminary Objection.

You fit go read di tori…READ MORE