fbpx
December 22, 2024

Elections: Saturday na opportunity to reset Nigeria – Obi

elections-saturday-nigeria-obi

Di Labour Party presidential candidate, Peter Obi, yarn say next Saturday elections na Nigerians lifetime opportunity to reset and reboot Nigeria in all aspects including leadership and governance, security of life and properties, economic and political freedom.

Also, Obi insist say Nigeria get di required human capital necessary for good leadership. However, na only selfish pipo dey make Naija dey anyhow.

Di Labour Party candidate tok this one during zoom meeting with supporters. Hin add say issues of national interest need to dey addressed urgently, and di process go start on February 25.

FOR MORE NEWS: New naira: FCT lawyers dey face frustration for filing proceedings

Obi yarn say we dey down to crunch time – seven days to di main day. Our strength dey for our diversity. We need to reset and reboot Nigeria in all ramifications – leadership and governance, security of life and properties, economic and political freedom.

In addition, Obi yarn say Nigeria must celebrate di shared values and responsibilities, and this Saturday elections na opportunity to reset di nation. Inside this march to freedom, hin yarn say no be for himself e come out, but hin come out for di millions of youths wey dey losing hope in our beloved country!

Hin yarn say him and Datti wish to deliver a new Nigeria and e dey possible!

You fit go read di full tori…READ MORE