fbpx
May 6, 2024

New naira: FCT lawyers dey face frustration for filing proceedings

new-naira-dey-cause-frustration-for-lawyers

Lawyers and litigants for di Federal Capital Territory, Abuja, don express frustration over dia inability to file court proceedings because of di scarcity of new naira notes.

Di News Agency of Nigeria interview some lawyers on Sunday and dem gather say di lawyers for Abuja dey worry as di situation dey affect dia legal practice.

Mr Cleansman Ogidi, for di Federal High Court, Maitama, tell NAN say di situation don cause delay, obstruction and frustration to most lawyers for di filing of proceedings for courts.

Ogidi yarn say he wan filie motion on notice, but he no fit because di money no dey available to pay for di filing fees.

According to am, since di issue of this currency swap, dem neva find things easy for courts, no be only for that High Court, even other courts for di FCT.

FOR MORE NEWS: “Always dramatic every year, I feel for di pikin” — Tonto Dikeh tag Churchill as deadbeat father, netizens don react

Also, hin yarn say dem no get cash to process proceedings and if dem wan do online payment, di network no dey easy to access.

Di Point Of Service operators sef no get cash to give dia customers.

Another lawyer, Mr Wilson Adodo, for Karu, FCT Magistrate Court, yarn say he dey frustrated because of di inability to make payment online for filing fees to enable am file application for bail.

According to am, “as long hin no fit file di application for bail, hin client go remain inside prison custody.

You fit go read di full tori…READ MORE