fbpx
May 19, 2024

#EndSARS: 103 corpses no be victims of Lekki tollgate – Lagos govt

endsars-victims-not-from-lekki-tollgate

Di Lagos State Ministry of Health yarn say di 103 victims of di 2020 EndSARS protests wey dem give given mass burial na for di aftermath of violence wey happen for plenty parts of di state and not from di Lekki TollGate as falsely reported in some social media publications.

Also, Permanent Secretary of di Ministry, Dr Olusegun Ogboye inside statement titled “RE: Mass burial of EndSARS victims, mischief makers at work” on Sunday, yarn say no be for Lekki Toll-gate dem pick di 103 casualties wey dem mention for di document.

Hin tok say na violence for many parts of di state and not from Lekki Toll-gate as pipo claim.

 

FOR MORE NEWS: Presidential election: Heavens no go fall if justice is done, Atiku reply Tinubu

 

In addition, A letter with di subject: ”No objection to mass burial of 103 victims of the year 2020 EndSARS” with reference no. LSMH/G/NS/013-1/23 bin surface online.

Di letter dey addressed to di Permanent Secretary, Ministry of Health, and signed by di Director General for di ministry, Mr. Onafowote Fatai Idowu surface on top social media space. Also, di letter show say na mass burial dem do for di 103 casualties from Lekki Toll Gate.

To set di record straight, Ogboye yarn say di social media publications na lie and dem concoct am to misinform di public, stir public sentiment and cause public disaffection against di Lagos State Government, hin say di EndSARS victims are not from Lekki TollGate

You fit go read di tori…READ MORE