fbpx
May 18, 2024

Mmesoma: I support sanctions wey JAMB impose – Ezekwesili

Former-minister-of-education-Ezekwesili-don-react-to-mmesoma-result

A former minister of education, Obiageli Ezekwesili don react to di findings of di committee set up by di Anambra State governor, Charles Soludo to investigate di saga between di Joint Admissions and Matriculation Board, JAMB, and Ejikeme Mmesoma over her UTME result.

Ezekwesili yarn say she support di sanctions wey JAMB impose on her. Also she yarn say e go serve as a warning to all di pipo wey dey participate in di systemic exam malpractices within di nation educational system.

Di committee discover say Mmesoma forge di 362 score wey she bin parade against di authentic score, 249.

In addition, Ezekwesili yarn say she dey satisfied with di process and di findings of committee wey give Mmesoma fair hearing.

Inside statement via her verified Twitter handle on Saturday, di former Minister recommend a sustained counseling for Mmesoma by her family, school and church.

 

FOR MORE NEWS: Guinness World Record: Mixed reactions don follow attempts by Nigerians

 

She write say she don read di report of di Committee set up by Anambra State Government to investigate and report dia independent findings on di Mmesoma and JAMB Saga.

Also, she yarn say e dey necessary to have independent evidence say di result wey Mmesoma claim publicly say na her own no be only  fake but she personally forge am by herself.

In addition, she yarn say syndicates always dey full di center to do exam malpractices for Nigeria but no be di same with Mmesoma case from di facts of di Committee report.

You fit go read di tori see as Ezekwesili react to Mmesoma result…READ MORE