fbpx
December 30, 2024

“I need to sue this guy” – Iyabo Ojo dey vex after Dacoster recreate her N37.5million AMVCA dress

fan-spoil-iyabo-ojo-amvca-dress

Actress Iyabo Ojo cry well well after fan spoil her expensive dress for di recent AMVCA 2023 event for Lagos.

Remember say earlier dis month, celebrities from all walks of life enter di Eko Hotel and Suites in style, Victoria Island, Lagos, for di 9th edition of di Africa Magic Viewers Choice Awards (AMVCA) 2023.

Iyabo Ojo don reveal how much she pay for di stunning, glamorous dress. She reveal say hin spent $50,000, or around N37.5 million in Nigerian currency. Toyin Lawani, a famous stylist, na hin create am.

FOR MORE NEWS: Yul Edochie share video of himself and wife, Judy Austin for praise and worship session

 

As she repost di video on top Instagram of di fan wey mimick her appearance for di AMVCA, Iyabo Ojo vex tok say he dey find Idan lawyer so dat she go sue di guy………

nobody should beg me oooo, we shall meet in court ………. my $50,000 💵 dress, no wayyyyyy…Na wetin she tok be dat.

Di revelation of di amount wey she spend don spark reactions from her fans.

One of dem on top Instagram write “Be calming down ….$50,000 wey you suppose take support motherless. You spend am for just one cloth”

While another write “U mean this dress is 37.5 million ???????”

You fit go read di tori as Fan spoil Iyabo Ojo AMVCA dress…READ MORE