fbpx
September 30, 2024

Federal Government Don Set Up Emergency Response Centre For Security Of Schools

federal-government-response-centre

Di federal government don flag-off di National Schools Security and Emergency Response Centre, so that dem go fit respond to emergencies across all schools for di country. Di centre dey located for di Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC) headquarters for Abuja.

Minister of Finance, Budget and National Planning, Mrs Zainab Ahmed yarn say di centre go provide consistent approach to di planning, management and reporting of threats and attacks for Schools in an organized manner.

Mr Clem Agba, di minister follow yarn say di response centre wey federal government set, dey designed to strategically plan smart and sustainable intelligence information gathering and sharing location wey go dey managed by professional security personnel.

FOR MORE NEWS: President Buhari don extend N200 notes validity by 60 days

Also, di centre dey expected to enable emergency communications and provide monitoring tools through di Common Emergency Communication and Information System (CECIS).

This na web-based alert and notification application wey go enable real-time exchange of information. E go also change di analog approach to quick fix or negligence of minor responsibilities to smart steps.

In addition, hin yarn say di flag-off mark di commencement of di implementation of di Safe Schools program, wey attests to di Federal Government commitment in providing Safe and cured teaching and learning environment for children.
You fit go read di full tori…READ MORE