fbpx
May 18, 2024

BREAKING: FG file fresh charges against Emefiele, to withdraw firearm case

federal-government-case-against-emefiele

Di Federal Government on Tuesday apply to withdraw di“illegal possession of firearms” case dem file against di suspended Central Bank of Nigeria (CBN) Governor, Godwin Emefiele.

Also, di Director of Public Prosecutions (DPP) for di Federal Ministry of Justice, Mohammed Abubakar, inside oral application, tell Justice Nicholas Oweibo for di Federal High Court sitting in Lagos State say di application follow di result of further investigations.

But, Emefiele counsel, Senior Advocate of Nigeria, Joseph Daudu, oppose di application.

 

FOR MORE NEWS: Sexual harassment: UNICAL student protest against varsity don

 

Hin insist say di government must first purge itself of di disobedience of di court order wey grant Emefiele bail before dem go accept di application.

Justice Oweibo don adjourn am till Thursday, August 17, 2023, to rule on di application.

Speaking to newsmen, di DPP yarn say fresh 20 counts dey filed for di Federal Capital Territory (FCT) High Court.

One of di counts, accuse Emefiele of “conferring unlawful advantages”. Na wetin hin tok be dat.

You fit go read your tori see Federal Government case against Emefiele…READ MORE