fbpx
April 27, 2024

Flight wey suppose go Abuja land for Asaba, kasala dey

flight-to-abuja-land-for-asaba

Wahala burst on Sunday as United Nigeria Airlines (UNA) flight from Lagos to Abuja land for Asaba, Delta State instead, because weather for Nnamdi Azikiwe International Airport no gree.

Di UNA 0504 flight waka from Murtala Muhammed Airport Terminal Two (MMA2) dey go Abuja.

Former media aide to Kano State Governor, Abdullahi Ganduje, Salihu ‘Dawisu’ Tanko Yakasai, carry di tori go him X page, talk say di crew yan say dem don land for Abuja, but na Asaba dem land.

E write; “Nigeria my country. We commot Lagos about one hour wey @flyunitedng waka go Abuja, and as we land, di crew talk with confidence say we don land Abuja, na so we come see say na Asaba we land. E be like say our pilot collect wrong flight plan from Lagos.”

 

FOR MORE NEWS: May Edochie and Rita Dominic dey share beta time for fashion show

 

But di airline later talk for statement say, na because of “poor destination weather” make dem do small waka go Asaba. Dem talk say the pilot know about the small waka, and e no spoil anytin.

Dem talk say di confusion start as cabin crew yan say dem don land for Abuja, but later di plane land well for Abuja after weather mago mago for Asaba.

United Nigeria Airlines yan say dem dey serious about di safety of dem passengers, and dem go dey do beta at all times.

You fit go read di tori of di Flight to Abuja wey land for Asaba….READ MORE